Cubana chief priest welcomes a baby with his Kenyan side he

 Popular Nigerian money mogul, Cubana Chief Priest allegedly impregnates his  Kenyan side chic
gistloversgram_media
Verified

Hello tueh tueh, GLB NATION otun ti zeh ooo, Congratulations are in order as Cubana chief priest welcomes a baby with his Kenyan side hen🚶🚶🚶🚶
Na jeje I dey last year ooo wey side hen come meet me say she get belle ooo, ha belle keh, Chief priest don get wife ooo why your puna no dey stay one place, them swear for you🙄🙄she talk say she be Kenyan and she just came to Lagos newly that time na him she jam Cubana chief priest (Pascal) say one thing led to another and she got pregnant, she talk say she tell Pascal but he told her not to abort the baby but stopped picking her call and blocked her everywhere on the long run,fast forward to 2023 naso she born boy ooo, she no gree me rest ever since she don born, when them dey panachuku(knack) I no dey there oooo, why be say na me them dey carry wahala come meet later🤦🤦🤦as she don born Sha she talk say she use her friend number take call Pascal and Pascal say the pikin na b@$tard, maybe the ogogoro wey Pascal drink when him talk say make the girl keep belle the ogogoro don clear 🤣🤣🤣🤣🤣she say Pascal block her friend too and that she can't take care of the baby alone say she challenge Cubana chiefprist(Pascal) to come for DNA oooo, which kind wahala be this, chiefprist your wandering prick don give person belle ooo, go collect pikin ooo, GLB NATION how we go settle this matter like this ?? Me I tire ooooo🚶🚶🚶🚶🚶🚶🚶🚶🚶🚶🚶🤦🤦🤦🤦 igi Ewedu oni wo pawa ooo, I come in peace

No comments:

Post a Comment

a2

Popular Posts